Advertisementspot_imgspot_img
17.1 C
Delhi
Friday, March 20, 2026
Advertismentspot_imgspot_img

Ozoro rape festival videos: Delta State government, police arrest community head over videos of ozoro cultural festival

Date:


Delta State Govnor

Wia dis foto come from, X/@RtHonSherriff

Read am in 4 mins

Delta State Command don annouce say dem arrest six pipo for di molestation of women for Delta state. Di arrest include di alleged chief organiser wey dem dey call Omorede Sunday

Dis dey come as one festival wey dey give men chance to do women anyhow for Delta state dey make many pipo vex for Nigeria.

Dem dey call am Ozoro Festival, event wey di videos don go viral show wia women become victims of molestation .

Di videos show how group of men dey tear women clothes. Dem dey drag some of dem comot from inside keke and from ontop bikes.

Di videos wey go make pesin vex don ginger di Commissioner of Police for Delta State to order investigate di mata of sexual assault wey dey allegedly happun as part of di Ozoro festival for di state.

For statement wey di State Command PPRO, SP Bright Edafe bring come outside a ask for pipo wey get informate wey go aid di investigation to comot wit am.

E say dem don arrest di community head and chief organiser of di event, one chief Omorede Sunday and four oda suspects from Oramudu quarters.

Bright Efe say di Commissioner of police don “order dia transfer to di State CID with immediate effect. Di Commissioner of Police vow say dem arrest anybody wey involve and bring dem to justice.”

Skip X post

Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

No be only di police don chook mouth inside di mata, di Delta State govment don also condemn di attacks wey dem call barbaric and unacceptable.

For statement on Friday, di Commissioner for Works (Rural Roads) and Public Information, Charles Aniagwu bin call on security agencies to investige di mata as dem hammer di pont say, “no cultural celebration fit justify criminality”.

Oga Aniagwu add say, “di Delta State Govment dey strongly condemn di harassment of ladies and reported cases of rape for di Ozoro Festival. Dat kain babaric acts dey totally unacceptable and no get place for our society”.

Howeva, Aniagwu add say, “we dey call on di police and oda security agencies to comot di pepetrators of dis heinous acts and bring dem to justice. No pesin or group suppose dey allowed to hide under festival do criminal tins.”

Ozoro Kingdom na di capital of Isoko North local goment for Delta state and tori be say e dey made up of five different kingdoms.

Wetin be Ozoro Festival

Na Uruamudhu Community dey practice am, and dem be one of di five communities wey form Ozoro Kingdom.

Wetin di Alue-Do be na festival of fertility and e dey believed to bring blessings of pikin dem to married couple wey dey find am hard to born.

How di practice dey work be say pipo go playfully drag pipo wey don marry and neva born for town and pour sand on top of dem as tradition wey go ginger fertility.

Representatives from di National Association of Nigerian Students wey post video say dem visit di leadership of Ozoro kingdom also admit say di cultural practice an for fertility purpose.





Source link

Share post:

Advertisementspot_imgspot_img

Popular

More like this
Related

AIIMS-Delhi to study link between lung cancer and air pollution | India News

The AIIMS-Delhi is studying links between exposure...

Core sector output slows to 2.3% in February; crude, gas and refinery drag weighs on momentum

Growth in India’s eight core infrastructure industries...

US universities pivot to AI degrees as campuses race to match the machine age

US higher education is undergoing a decisive shift...
Advertisementspot_imgspot_img